good people good country... 200 million mumu
piss for dem mouth, shit for dem head, march dem for potopoto
thief them, suffer them, subsidy them... wetin go happen?
rape them, kill them, assassinate them... wetin go happen?
them go shout small for internet
write big english for paper
make mouth for radio
analyze for television
but wetin go happen?
nothing go happen... na 200 million mumu
wetin you think dem go do... suffer done reach gegele
you go think dem go vote for change ... when baboon dey chop monkey
but wetin go happen?
nothing go happen... na 200 million mumu
200 million dundee... 200 million mumu
Read more...